On Air Now

Football Republik

2:00pm - 6:00pm

Time Don Reach To Find New Independence - Sowore

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Former Presidential Candidate, Omoyele Sowore, tok say timedon reach for Nigeria to find New Independence from internal colonizers

Sowore follow awa sister station tok on Tuesday say, "Independence no be wetin dem dey give; na sometin wey you go collect and go dey use always".

He tok say di Independence wey Nigeria dey celebrate on 1 October, dem achieve am by protesting.

He still tok say di democracy wey Nigeria dey practice since 1999 dem achieve am from protests.

Di Presidential Candidate tok say "maybe pipo no know di power of protest to get liberation".

"Pipo wey tok say protests no dey work never join protest.

Sowore mention say Nigeria dey ready for change wey go start from march, rallies, education, den plenty pipo go rise up".


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 29°C | Low: 21°C