On Air Now

Una Wake Up Show

5:00am - 10:00am

Naija Army Don Scatta 15 Area Wey Dem Dey Make Fake Fuel Inside

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di Nigerian Army 6th Division don report say dem burst 15 area wey dey do the business of to dey make fuel and oda petrol product wey government no give dem go ahead to make. Dem also arrest 10 suspects for di places wey dey for Niger Delta.

Dis waka of to dey make fuel and other petrol product without government go ahead, no follow wetin our law for Nigeria tok. And pipu wey dey run this business for we kontri also dey chook hand inside tiff-tiff of crude oil inside we kontri.

Di army tok say di site wey dem scatta na for Rivers, Bayelsa, Delta and Akwa Ibom.

According to di army, di 6th division soldiers collect around 115,000 liters of crude oil wey di suspects thief.

Lt.Col.Jonah Danjuma, di acting Deputy Director of Army Public Relations for di division, release dis information for statement wey dem issue for Port Harcourt on Sunday.

Danjuma tok say dis achievment na from di army steadfast position against illegal bunkering and eim also tok about how dem take catch di suspects.

Di 6th Division spokesperson also tok say di operations lead to recovery of tins wey dem dey use for economic damage for di area.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 26°C | Low: 21°C