On Air Now

Saturday Flavour

6:00pm - 10:00pm

LASG Commot People Wey Build Rooms Under Eko Bridge, Arrest One Man

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

The Lagos Environmental Sanitation Corps (LAGESC), wey people sabi as KAI, don chase illegal occupants wey build 84 rooms under Eko Bridge for Elegbata, Lagos Island.

LAGESC Corps Marshal, retired Maj. Olanini Cole, talk this one for statement wey agency spokesperson, Mr. Lukman Ajayi, release for Lagos on Monday.

Cole tok say dem arrest one man wey build eight-room toilet for there and connect the pipes into Lagoon. Dem say the operation happen after one person report say dem attack am for that area.

After the attack, the person write petition to the Commissioner for Environment, wey come give order make dem clear the illegal structures.

Cole still tok say some of the people wey dem chase don dey live there for almost 30 years.

"E surprise us say eight toilet pipes connect enter Lagoon, near where fishermen dey fish. Some of the people sef dey cook food for public there,” Cole talk. “The water dem dey use fit cause health problem. One person wey operate the toilet don dey police hand."

Him add say the pipu wey dem commot tok say dem no get money to rent better place, na why dem dey live for there.

Cole still talk say this kind operation go continue for different parts of Lagos State to clear illegal people from black spots.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 19°C