On Air Now

Una Wake Up Show

5:00am - 10:00am

If di new bill pass, Nigerians Wey dey earn over N100m monthly go fit pay 25% tax - FG

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di Chairman of di Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, yarn dis one for one break out session during di Nigeria Economic Summit wey NESG organize.


Im talk say di people wey dey earn over 100m monthly, wey be di rich people, suppose dey pay 25% tax

Oyedele explain say di 25% tax wey dem wan put for di rich people na to balance things make e reduce di tax wahala for people wey no dey earn plenty, while the higher-income people go dey contribute more to government revenue

E still yarn say di Federal Government get plan to pay businesses back 100% of di Value Added Tax  (VAT) wey dem don pay for asset and services. Dis one na to help encourage businesses and grow di economy.


 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 26°C | Low: 21°C