Di United States don announce say dem go support di pipo wey flood affect inside Naija wit di amount of 1 Million Dollar.
Di person wey dey represent United State for inside Naija aka U.S Ambassador, Mary Beth Leonard tok say body no sweet dem at all wit wetin dey go on for inside Naija as plenty plenty pipo don die and many oda pipo too don loss dia houseand notin to even chop as water carry eveything go but say di U.S stand gidigba wit di pipo of Naija for dis hard time.
Di U.S Agency for International Development aka USAID na dem dey provide
dis money to carry support pipo wey di flood palava affect.