On Air Now

Non Stop Music

10:00pm - 6:00am

Rivers Crisis: Governor Fubara Don Swear in Caretaker Chairmen For 23 Local Government

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Ogu/Bolo LGA get Evans Bipi, and Okrika LGA na Princess Ogan wey dem give...

Rivers State Govoh wey be His Excellency Siminalayi Fubara don swear in new new Caretaker chairmen dem for the 23 Local Government Area wey Dey Rivers State.

Govoh been forward this list of dem appointed caretaker chairmen when dem still be nominees give House of Assembly on Tuesday as dem been invite them come for screening by 8’ O’clock am on Wednesday morning. The person wey sama this informate na G.M. Gillis-West, wey be Clerk of the House.

As wahala and tension Dey go round the state based on say chairmen dem wey their tenure don expire no gree comot for chair, na em Govoh come swear in dis pipo.

As e be so, people wey dem swear in as caretaker chairman for the 23 local government for the state be: Madigai Dickson for Abua/Odua LGA. For  Ahoada East LGA, na Happy Benneth and for Ahoada West LGA na Daddy John Green.

Also for Akuku Toru LGA na Otonye Briggs and for Andoni LGA the caretaker chairman na Reginald Ekaan. For Asari Toru LGA na Orolosoma Amachree and for Bonny LGA na Alabota Anengi Barasua.

Ahead ahead for Degema LGA na Anthony Soberekon and for Eleme LGA na Brain Gokpa, for Emouha LGA na David Omereji, and Etche LGA come get John Otamiri, while for Gokana LGA na Kenneth Kpeden.

Still on the mata, for Ikwerre LGA na Darlington Orji, for Khana LGA na Marvin Yobana, for Obia/Akpor LGA na Chijioke Ihunwo, and for Ogba/Egbema/Ndoni LGA na Princewill Ejekwe.

Ogu/Bolo LGA get Evans Bipi, and Okrika LGA na Princess Ogan wey dem give. For Omuma LGA the caretaker chairman na Promise Reginald, for Opobo/Nkoro LGA na Enyiada Cookey-Gam and for Oyigbo LGA na Gogo Philip

Port Harcourt LGA na Ichemati Ezebunwo and las las for Tai LGA na Matthew Dike.

Dis caretaker chairmen dem go Dey over see wetin Dey sup for Local Government wey Dey Rivers state.
 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Light rain

    High: 31°C | Low: 23°C