Dem don carry beta recognize sama Better Sabi person on top Media mata and person wey dey show way for media issue dem Uche Nwaneri. This one shele for Lagos inside Nigeria on the 20 day of December 2024.
Uche Nwaneri wey everybody sabi on top media waka for nearly 30 year na him International Council of Management Consulting Institute(ICMCI) sama Fellowship of the Institute of Management Consultants (FIMC Nigeria) by the International Council of Management Consulting Institutes (ICMC).
This recognise na to tell world people say Uche Nwaneri na kajad pesin inside media mata.
More than 50 country for obodo world recognize this cefiticate.
Uche Nwaneri be Programs Manager on top Wazobia FM Lagos since February 2021. Wazobia FM na ogbonge radio station for obodo world and na the radio station wey big pass for Africa if na to look business and pipo wey dey follow am. Him don show say him different as e sabi and dey do him work. Dis FIMC wey him qualify for don talk am finish.
When dem put microphone for him mouth e talk say .... My belle sweet to collect this recognize, no be only the exam wen I pass dey totori me but say my work show.
As I be consultant and sabi person on top media mata, na only the correct thing go dey my hand and mouth to do. As I don mature reach to dey among sabi people on top obodo world. I no go stop but to dey push dey go ahead ahead for client dem and obodo world pipo.
Nwaneri record no get any gbege cha cha even as e don dey the game for nearly 30 year. E still follow be advert practitioner (arpa) join, E go sweet your belle to know say IMC (Institute of management consultants) na world organization wey dem consine na to promote excellent on top management consulting.
FIMC Nigeria fellowship na the highest qualify wey person fit qualify on top management consultancy matter for obodo world and na only kajad professional dem dey gree enter am.
FOR MORE INFORMATE MAKE YOU HALLA UCHE NWANERI WEY BE PROGRAMS MANAGER WAZOBIA FM LAGOS. PHONE +234803036691. SOCIALS :- @STRETCHORIGINAL(IG), @STRETCHCOOL(X)