On Air Now

Non Stop Music

10:00pm - 6:00am

Onyeka Onwenu don die at 72

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Naija music legend, Onyeka Onwenu, wey people sabi as 'Elegant Stallion', don die at di age of 72.

Report say Onwenu collapse afta she perform for di 80th birthday party of Stella Okoli, Chief Executive Officer of Emzor Pharmaceuticals, on Tuesday.

Dem rush am go Reddington Hospital, where dem tok say she later die.

One source, wey no wan make dem know am, talk say, 'E very sad. Onyeka Onwenu just perform for di birthday of Mrs. Stella Okoli of Emzor Pharmaceuticals tonight. After she perform finish, she collapse. Dem carry am go Reddington Hospital but she no make am.'

Onwenu born for 1952, for Obosi, Anambra State.

She start her music career for di 1980s and release her debut album, 'For the Love of You,' for 1981.

Since then, she don release many albums and singles, including di hit song, 'One Love'.

Onwenu don act for plenty Nollywood films and win plenty awards for her contributions to music and film.

Apart from her entertainment career, Onwenu also enter politics.

She bin dey as Chairperson of di Imo State Council for Arts and Culture for 2013 and later become di Director-General of di National Centre for Women Development for 2016.

She collect di National Honours of Member of di Order of di Federal Republic (MFR) for 2011."


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thunder storm

    High: 28°C | Low: 24°C