On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Naomi Silekunola, Others Go Face Court For Matter Wey Concern Stampede Wey Shele For Ibadan.

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Oyo State goment don carry matter go court sharp-sharp, weeks afta di stampede wey shele for 18 December 2024 children funfair wey dem do for Islamic High School, Bashorun, Ibadan.

For January 10, 2025, di Oyo State govment don file eight-count charge of murder, manslaughter, and criminal negligence against Naomi Silekunola, wey be former wife of di Ooni of Ife; Oriyomi Hamzat, wey be owner of one Ibadan radio station; and Abdulahi Fasasi, wey be di school principal.

Di charges wey dem file for Oyo State High Court talk say na lack of proper crowd control, security, and medical facilities na wetin cause di death of plenty pikin dem, wey age range dey between 1.5 to 18 years.

Governor Seyi Makinde don vow say dem go find justice for di victims, and im talk say di tragedy for no happun if proper planning dey.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 23°C