On Air Now

Non Stop Music

10:00pm - 6:00am

FG Re-Open Water Labs Dem To Fight Cholera

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Minister of water resources and sanitation, PROF.Joseph Utsev, Say dem don wake up laboratory for six geopolitical zones to stop cholera wey dey spread.`


Tuesday June 25, na Lagos Internatioal Water Conference, Utsev tok about how dem go finance water and sanitation for Lagos to dey better. 

Dis action show say dem dey proactive for public health management, and e tok how important strong infrastructure dey to fight infectious diseases,"he yarn the conference pipo.

Utsev tok say make dem teach people how to dey clean treat dia, boil am, cook food and vegetables well well.

"He yarn say make state governors, private sectors , and developement partners put more money for water and sanitation matter".

He promise the state say federal government say e go support dem with plans to make the people get better sanitation and water wey dey clean and safe.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Light rain

    High: 31°C | Low: 23°C