The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don respond to the dragging wey people drag dem about why dem no show di owner of di big Abuja estate wey dem gba and give di Federal Government on Monday.
Di estate, wey be 150,500 square meters with 753 duplexes and oda apartments, na di biggest single asset wey EFCC don gbab since dem start for 2003.
Why Dem No Show di Owner
For statement wey EFCC tok on Tuesday, di spokesperson, Dele Oyewale, yarn say investigation about di criminal matter still dey go on, and e no go make sense to mention anybody name when di case neva complete.
“Di main investigation dey continue. To call person name when di title document no directly link dem to di property go be unprofessional,” Mr. Oyewale tok.
E still add say di company wey EFCC suspect as di owner don deny say di estate belong to dem. Based on this, EFCC use di Section 17 of di Advance Fee Fraud Act to follow di case as civil matter wey target di property, no be di person.
Wahala About Who Get Am
According to Omoyele Sowore, di publisher of Sahara Reporters, eim tok say EFCC dey hide the name of the person, and di property dey connected to Godwin Emefiele, di former governor of di Central Bank of Nigeria (CBN).
Mr. Oyewale sharply tok say, wetin Sowore yarn dey “unacceptable” and make Mr. Sowore allow dem finish to chook eye for the mata so that dem go fit know how e take happen.
Court Process and Next Steps
EFCC tok say di Abuja High Court judge, Justice Jude Onwuegbuzie, grant di final forfeiture order after EFCC show evidence wey make dem find colobi the property.
Di agency promise say di investigation go continue to show who get am and how dem take get property. Meanwhile, EFCC don tell Nigerians say make dem take cold water cool dia temper as dia eye still dey shine to make sure say wuru-wuru no dey for the mata.
Di matter don cause gbas-gbos for public space, with Nigerians dey ask for more answers about di estate ownership.