On Air Now

Football Republik

2:00pm - 8:00pm

Dem Don Confam Kekere-Ekun As CJN

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Dem don confam Justice Kudirat Kekere-Ekun as substantive Chief Justice of Nigeria (CJN)

 

Di confamation for Wednesday follow request from Bola Tinubu, wey forward di name of di nominee to senate for appointment as Nigeria substantive CJN

Di senate wey take over by Godswill Akpabio suspend im rules, come admit Justice Kekere-Ekun into di chambers to make am deal with questions wey lawmakers go ask, lawmakers wey don resolve for confamation hearing.

To handle questions from Deputy President of the Senate, Jibrin Barau and Chief Whip, Mohammed Monguno and Justice Kekere-Ekun maintain di integrity of di Judiciary go sustain under am with full obedience to di code of ethics .

She come advise say limit suppose dey for cases wey dey go Supreme Court, she also tok say pre-election mata for example must be terminated for Court of Appeal.

As she dey stress di need for National Judicial Council to make sure say petitions dey handled sharp sharp. She still tok about di need to protect the Judiciary from all external influences.

Her confamation dey in accordance with Section 231(1) for di 1999 Constitution as dey don amend.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C