
Nigeria go dey look to enter final for di first time in di history of dis competition
Nigeria go play Columbia for di semi-final of di FIFA U-17 Women's World Cup and ontop dis level, dis go be di first time wey di 2 teams dey enter semi-final.
USA wey bin enter di quarter-final match against Nigeria as favourites bin lose on penalties after normal time.
For dis level of football, Nigeria go dey look to continue di 100% record against Columbia as dem bin win di South Americans twice before now.
Di semi-final match go shele by 12 noon (Nigerian Time) for inside Pandit Jawaharlal Nehru Stadium, India.