On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Wazobia PH Don Join Bodie With Free Mobile Library

As he tok am, "School alone no fit make person dey educated but reading of books fit make person dey both educated and enlightened."

Inside #Asedeyhot with Sisi Boma for Wazobia FM, Port Harcourt; one man wey him name na Xolomon Wuche say he bin don start one initiative wey dem call Free Mobile Library

The idea of this initiative na to take helep share books, plus other educational materials for small small communities for inside Rivers State.

He tok say he bin don already do d first edition of diz free mobile library for 2017, say that time, he bin don cover twenty one communities for the seven days wey he take do am.

He tok say e dey plan to cover five communities this time around, and say the target na to give out 50,000 educational books and ten thousand exercise books to children as e be say plenty people for rural communities no fit afford these things.

As he tok am, "School alone no fit make person dey educated but reading of books fit make person dey both educated and enlightened."

"As e be say I sabi plenty things wey dey happen outside we country, not because say I don comot for awa country before but because say I dey read well well; and na diz same thing I wan do for our African communities."

He follow tok say diz books wey him wan share go take  helep our young people dem to develop reading habit wey go help dem become better people for we society wen dem grow.

He come follow advise people say make dem no just collect diz book keep for house but make dem also read am as e go help dem.

He dey call on our country people, organizations, and people wey like better things to come support this movement by donating books, money, plus other educational materials to take helep them achieve diz goal.

Wazobia 94.1 FM, Port Harcourt, and awa sister stations, Nigeria Info FM and Cool FM follow with them dey do this thing


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C