Presido Bola Tinubu don order a review of his government’s conditional cash transfer program for di transfer of N8,000 to pepo to help dem cover up di effects of fuel subsidy removal.
Dis one kon follow widespread concerns by Nigerians about how di sharing go be like and how far di money go fit help dem.
The Presido wey eim name na Bola Ahmed Tinubu don direct di intro of di entire package wey di government wan give Nigerians and di release of fertilizer and grains to up to 50 million farmers and pepo for all di 36 states and di FCT.
Presidential spokesman wey eim name na Dele Alake, tok for one statement say Presido don promise Nigerians say di N500 billion wey di National Assembly don approve na to cover up di pain wey di subsidy removal don cause.
He kon still tok say for dis mata dem no go be any ethnic, religious, or political wahala wen dem dey select pepo wey dem go give dis package to.
Presido don still tok say di decision wey eim administration don dey take since na base on di e total commitment to improve di general well-being of Nigerians.
Last week, di federal government don propose to give 12 million pepo wey dey receive low salary N8,000 monthly for six months and other mede-mede to help pepo cover up di wahala wey fuel subsidy don cause.
How una see dis mata??
#Chookmouth