On Air Now

Satide Mede Mede

8:00pm - Midnight

Sheik Gumi Tok Say Nigerian Security Forces Know Wia Bandit Dem Dey

Di Islamic cleric Sheikh Ahmed Gumi don tok say Nigerian security forces know wia di bandits wey dey cause wahala for Northern Nigeria dey.

Sheik Ahmed Gumi tok dis one as im and Maryann Okon of Nigeria Info Lagos FM dey tok for Hard Facts on Monday 

Im say anytime im dey go meet di bandit to negotiate with dem say Nigerian Security Forces dem dey go with am.

Gumi tok say e fit be say military no wan attack di bandits bcos of dem no want make innocent pipo die anyhow.


Sheik Gumi, na im be di person wey carry di bandits Amnesty and Negotiation mata for head.

Im mind be say make government give bandits amnesty as dem give di Niger Delta militants wey bin dey worry wella for South South before.


Im tok say make government no use force follow di bandits, say make dem negotiate with dem.

Gumi still tok say if military use force di small pikin dem wey dey di bandit hand fit die.

Im say di pikin dem dey innocent, dem no know anytin for wetin happun and dem just be victims of di wahala wey dey ground.

Im come tok say make government try to do everything, to commot di pikin dem for bandit hand, say afta dat one dem fit do as dem like.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C