On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

Afenifere Leader, Pa Ayo Adebanjo, Don Kpai at 96

Popular Yoruba leader and elder statesman, Pa Ayo Adebanjo, don pass away at di age of 96. Di respected Afenifere leader die peacefully on Friday, February 14, 2025, for him house wey dey Lekki, Lagos.

Him family confirm di sad news for one statement wey dem release:
"Him die peacefully dis morning, Friday, February 14, 2025, for him Lekki, Lagos house at di age of 96."

Dem talk say arrangement still dey go on with him close people and big men for Nigeria and beyond to give am better burial. Di funeral plans go soon dey announced.

People wey wan sign condolence register fit go him Lekki Phase 1 house for Lagos or him village house for Isanya Ogbo, near Ijebu Ode, Ogun State.

Di statement carry di signatures of him pikin dem: Mrs. Ayotunde Atteh (née Ayo-Adebanjo), Mrs. Adeola Azeez (née Ayo-Adebanjo), and Mr. Obafemi Ayo-Adebanjo.

Pa Ayo Adebanjo go always remain for history as one great Yoruba leader wey fight for true federalism and better Nigeria. May im soul rest well. 🙏🏾


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 27°C