Claim: Chris Ngige bin advise APC make dem no celebrate di presidential election victory because of him experience for court with Peter Obi. Verdict: NA LIE. As we confirm from di spokesperson of Ngige wey talk say di minister no make dis kind statement.
Claim: Dem fit use Fasting as treatment for cancer. Verdict: MOST TIMES NA TRUE. Although dem don prove say fasting dey effective to treat cancer but no be di cure be dat.
Claim: The inflation rate today na around 16% but under di government of Peoples Democratic Party (PDP) na single figure e be .
Former leader dem under di military rule or for democracy get ogbonge role wey dem dey play for election mata inside Nigeria. Different important pipo dey take anything wey dis former leaders dem talk very serious especially di ones wey wan run for office .
Di management of Nnamdi Azikiwe University, Awka, don expel Precious Mbakwe, di student wey dem catch for viral video dey beat one lecturer.
Popular Yoruba leader and elder statesman, Pa Ayo Adebanjo, don pass away at di age of 96. Di respected Afenifere leader die peacefully on Friday, February 14, 2025, for him house wey dey Lekki, Lagos.
One U.S. lawmaker, Scott Perry, don accuse di United States Agency for International Development (USAID) say dem dey send money go Boko Haram, ISIS, Al-Qaeda and other terrorist groups.
Di Federal Executive Council (FEC) don approve $1.07 billion to better Nigeria health sector under di Human Capital Opportunities for Prosperity and Equity (HOPE) program.
At least 17 pikin don lose dia life as fire burn Islamic school for Kauran Namoda, Zamfara State. Plenty other students wey wound don rush go hospital for treatment.
Brigadier General Yushau Ahmed, wey be Director-General of di National Youth Service Corps (NYSC), don announce say corps members go dey collect N77,000 allawee every month, starting from February 2025.
Nigerian music star, Temilade Openiyi, wey everybody sabi as Tems, don make Nigeria proud again as she win her second Grammy Award for di 67th Grammy Awards wey happen for 2025.
Nigeria Labour Congress (NLC) don declare nationwide protest for February 4 bcos of di 50% increase wey Nigeria Communications Commission (NCC) put for telecom services.
Paris Saint-Germain don finally sign Khvicha Kvaratskhelia from Napoli as both clubs don seal di deal today.
Altay Bayindir and Joshua Zirkzee change from suspects to saviors as dem help Manchester United knack Arsenal for Emirates to waka enter FA Cup next round. Di Red Devils, wey play with ten men, still manage win di penalty shootout.
Super Eagles don finally get new coach wey go replace Finidi George as dem dey prepare for di World Cup qualifiers.
West Ham don confirm Graham Potter as dia new coach after dem sack Julen Lopetegui wey spend just six months for di job.
© Copyright 2025 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.