Why Men Dey Quick Tire For Dia Women Inside Relationship/Marriage

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Relationship na efforts from the two parties wey dey involve and e dey tire person when one party no dey put effort. This na wake up call to women wey dey too relaxed inside dia relationship/marriage.

Ontop Nightjolly with UZO , she talk some things wey dey make man tire for relationship, she say woman wey no dey show love, woman wey no dey put effort, woman wey no dey supportive.

She say, woman wey dey like dis, go make dia men tire quick for the relationship and she also ask Woman, if dia Men go fit beat dia chest tok say dia women dey supportive?

#chookmouth for comment section


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C