Senate don come out on Tuesday, come dey beg CBN say make shift di deadline wey dem put wey be 31st of January go July 31st wey we go stop to use di old naira note.
Video
Dem don kill 39 catholic priests and kidnap 30 since 2012. 17 catechists and more dan 3,500 catholic pipo dem kill since 2012.
Video
Di wife of late Chief MKO Abiola, wey be Prof.Zainab Abiola don carry Nigeria Police Force (NPF) and Inspector-General of Police , Usman Baba go Federal High Court for Abuja say dem go pay her N100billion bcos say dem spoil her name.
Video
The Medical and Dental Council of Nigeria don come out to come yarn say 439 doctors wey learn the work for abroad don fail the medical exam wey dem set for dem to know if dem really sabi the work.
Video
The Federal Government, through National Universities Commission (NUC), don ready to troway our old 60 years university curriculum. wey university for Naija dey use.
Di Oga Kpatakpata for inside Naija aka President Muhammadu Buhari don tok on Tuesday say na di effect of climate change na eim dey happen for inside different place for di country.
Video
President Buhari don warn the Minister for Water mata Suleman Hussein Adamu to bring plan wey go help end dis flood wahala.
Video
Di Candidate wey dey represent di All Progressive Congress alias APC for di presidential waka Ahmed Bola Tinubu don donate 100 million naira to di pipo wey flood affect for inside Kano State.
Video
According to di latest consumer price index{CPI} as di National Bureau for Statistics {NBS} tok,dem say di CPI don increase by 1.36% comapre to the 1.7% increase for di former month.
Video
The Court of Appeal for Abuja, Federal Capital Territory don chook eye for the case of the oga of IPOB, Nnamdi Kanu.
Video
Katsina State Deputy Governor, Alhaji Mannir Yakubu, tok say Federal Government don release N6.25 billion sake of to build cattle ranches for Katsina.
Video
Nigeria and di United States don sign agreement to return $23 million loot by former Head of State Sani Abacha.
Video
Nigeria Police Force don tell di public say make dem ignore di advertisement wey dey go round say dem want new pipo for police.
Video
Hassan Nasiha, Zamfara Deputy Govanor ,tok say Bello Turji wey evri bodi no as terrorist tell Government say e want Peace.
Video
Yemi Osinbajo do leg surgery for Lagos, sake of say eim injure when eim dey play squash.
Video
FG wan ban okada for the whole Nigeria, to stop insecurity wahala for di kontri. Abubakar Malami, attorney-general of di federation, tok dis one on Thursday afta di national security council meeting for di presidential villa, Abuja.
Video
Join bodi of bread makers for Nigeria say dia one week strike don start today.
Video
ASUU strike don enta 156 days since February 14, 2022. Presido say eim give ASUU 2 weeks make dem stop dia strike.
Video
Ministry Education for Lagos don close Redeemers Nursery and Primary School for Ogba, sake of 5 year old pikin wey die for di school when eim dey swim.
Video
General Overseer of Redeem Christian Church, Pastor Enoch Adeboye, say e no tell Christians make dem buy gun, say Christians no need guns. He say Samson for Bible no fight wit AK-47.
Video
Governor of Ondo State, Akeredolu say di pipo wey dey cause plenti badness for Naija, no be Nigerians.
Video
Police Public Relations Officer for Anambra, Ikenga Tochukwu, confirm di early-morning attack wey shele for Awka, Anambra. He say dis attack happen for around 4:30 am for Awada for Idemili North Local Government Area of the state.
Video
Naija economy grow at 3.11 percent for di first quarter of 2022, Q1’22, leading banks for di kontri don report 24.7 percent and 18.6 percent increase for revenue and profits for di same period.
Video
Dem dey sell up to 63 Million laptops, and phones dem for Nigeria evri year, na according to data from Original Equipment Manufacturers.
Video
Anambra Governor, Charles Soludo don declare curfew for 8 local government areas for di state, Aguata, Ihiala, Ekwusigo, Nnewi North, Nnewi south, Orumba North, Orumba south.
Video
Federal government wan put new tax ontop phone calls for di the country, say dem wan do free health care for pipo wey no fit afford am for Naija.
Video
EFCC arrest Ahmed Idris wey be Accountant General of di Federation, Dem say na real estate properties im take use di money do for Kano and Abuja.
Video
Thamina Mahmood just comot from di hand of pipo wey kidnap am. She get belle and base on record, na di second pesin wey d bad guys don release, afta March 28, 2022 Kaduna train attack.
Video
The student wey dem kill wey be, Deborah Samuel. Dem say she tok wetin no sweet dia belle about Prophet Mohammed.
Video
President Muhammadu Buhari don tell members of the Federal Executive Council (FEC) wey dey run for offices make dem resign before Monday the 16th of May, 2022.
Video
Members of South East zone of National Association of Nigerian Students (NANS) and deir pipo for Ogun and Oyo in the South West region don give federal government and Academic Staff Union of Universities (ASUU) 9 days to open all public universities for Nigeria.
Video
Nigerian Bar Association and civil rights groups on Monday, dey warn Central Bank of Nigeria Governor, Mr. Godwin Emefiele, say na big wahala he wan cause if he wan contest for 2023 election.
Video
Vice-president , Yemi Osinbajo say if e no contest for 2023 election na betrayal e go mean to di kontri.
Video
Aisha Buhari dey call for more women as running mate, as man dey run for Presido make eim running mate be woman.
Video
MC Oluomo boys and okada members fight bcos of tickets moni
Video
Vice President Yemi Osinbajo say he wan run for President of Nigeria 2023.
Video
Terrorists wey attack di Abuja-Kaduna train don threaten to kill di pipo wey dey deir hand, unless government follow dem tok.
Video
Lagos State don appoint Mc Oluomo Chairman Parks Management Committee
Video
Nigeria import don rise by N12.11 trillion even with forex shortage
Video
Bandits don kidnap 22 villagers for Abuja-Kaduna way
Video
Pastor Adeboye say eim no dey support any candidate for 2023 election
Video
Federal Government say deir hand clean for ASUU strike
Video
Inspector-General of Police, IGP Usman Alkali Baba and Chairman/Chief Executive Officer of the National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, Brig. Gen. Buba Marwa, retd, met for Force Headquarters, Abuja, make dem decide di fate of di suspended commander of the Police Force Intelligence Response Team, DCP Abba Kyari, say eim dey involve for 25kg cocaine deal.
Video
The Academic Staff Union of Universities don declare nationwide strike, President of ASUU, Prof. Emmanuel Osodeke, say di strike, go start from Monday, February 14, 2022, and go last for four weeks.
Video
5 Pipu die for di building wey collapse for Yaba
Video
Airlines wan review 200 thousand naira for covid-19 test
Video
Senegal don win AFCON 2021
Video
FG wan borrow $600 million from world bank to take deal with environmental crisis for 19 Northern States and Federal Capital Territory (FCT)
Video
Governor Wike say North no fit stop South make dem get PDP ticket
Video
Chairman of All Progressives Congress Caretaker/Extraordinary Convention Planning Committee, Mai Mala Buni, say APC don get over 41 million registered members, say na “Africa’s largest party”.
Video
Central Bank of Nigeria (CBN) dey blame high cost of food items ontop logistics wahala and the pipu wey hide food.
Video
FG say since 2015-2020 say Nigerians no dey pay Light bill again
Video
Minister of Health, Osagie Ehanire, say e dey worry say Nigeria continues to dey get di highest number of malaria for di world.
Video
Kano Govt don cancel di license of all di private Skool for Kano, bcos of di 5 years old girl Hanifa Abubakar wey di skool proprietor kidnap and kill.
Video
4 Pipu die for NURTW clash for Lagos Island
Video
House Of Reps members don order make dem find di 178,459 police guns wey dey miss
Video
Lagos state government don buy two train for the red line rail project wey dem dey do. Dis na de first metro system transport for West Africa.
Video
FG say if you neva take covid 19 vaccine, dem no go allow u enta public gatherings
Video
Postpone 2022 National Census - Northerners dey tell Presido Buhari
Video
Rivers State Governor, Wike say e no go spare anyone wey dey involved in Illegal refineries wey dey cause soot Pandemic for Port Harcourt.
Video
President Muhammadu Buhari don approve di lifting of di ban of Twitter operation for Nigeria.
Video
Buni, Malami dey move to block convention, and Governors wey dey rise against interim party chair
Video
Former Governor of Lagos state, Bola Ahmed say he don tell Presido Buhari say he wan contest for 2023 Presidential Election but he neva tell Nigerians.
Video
The Nigeria Labour Congress (NLC) don announce plans say dem go on nationwide protests on January 27, 2022, make dem protest against moves by the Nigerian government to increase fuel prices.
Video
Presido Buhari go sign 2022 budget on December 31, 2021
Video
Federal Government dey try push public debt stock to N50.22tn by 2023, domestic debt for N28.75tn and external debt for N21.47tn.
Video
Gunmen kidnap monarch and 7 odas for Plateau, Zaria and Ekiti for Christmas weekend
Video
Queen Silekunola Moronke Naomi Ogunwusi announce say "she no be queen of Ife again" as she don decide to move on.
Video
Road Safety, Amotekun don put camera for their officers body
Video
INEC say dem need 305 billion naira to arrange 2023 general election.
Video
De moni wey Nigeria dey owe China don enta 3.5 billion dollars.
Video
Lai Mohammed say na Presido Buhari stop Boko Haram, make dem no turn Nigeria to Islamic kontri.
Video
UK government don remove Nigeria, and 10 oda kontries from deir red list
Video
NYSC Director-General Shuaibu Ibrahim dey warn all di corp members wey wan serve for 2022, say if dem no take vaccine, dem no go allow dem enta camp.
Video
“Do me I do you ” na so FG wan do ontop dis Omicron waka.
Video
Nigeria wan do E-Cenus for 2022
Video
Nigeria don confirm de first cases of omicron coronavirus variant for three travellers wey enta de country last week, Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) tok.
Video
Independent Corrupt Practices and Other Related Offices Commission say, Federal Ministry of Labour and Employment, wey Chris Ngige be de Oga , and the University College Hospital, Ibadan, say dem dey do illegal job recruitments.
Video
FG tok say if civil servants for di kontri no take deir covid-19 vaccine b4 Dec 1, dem no go allow dem go work.
Video
Federal Government don tell Nigeria Customs Service make dem hold 91 private jets wey some billionaires get, bcos dem refuse to pay import duties wey don pass over N30bn.
Video
Senate, Trade Union Congress, TUC, and experts disagree with Federal Government’s plan to remove fuel subsidy for next year and replace am with N5,000 monthly transport grant to 40 million Nigerians.
Video
Former Aviation Minister, Femi Fani-Kayode, don confirm say Economic and Financial Crimes Commission(EFCC).
Video
Salary no dey increase but everything just dey cost for Nigeria. WAEC don increase exam fee to 18,000 from 13,000.
Video
Be brutal on bandits, kill dem, bring back deir weapons - Chief of army staff
Video
Governor of the Central Bank of Nigeria (CBN), Mr. Godwin Emefiele, say central bank don share N3 trillion to houses, small and medium scale enterprises (SMEs), smallholder farmers, pharmaceutical companies for Covid-19 pandemic.
Video
Academic Staff Union of Universities, ASUU, don give federal goment three weeks to do all de things wey dem dey ask for, if not lecturers go gba break.
Video
20,000 pipu wey dey do pure water work for Nigeria go loose deir work, sake of say price to make am don increase
Video
Army don burst 20 backyard refinery for Nigeria
Video
Farmers who join Central Bank of Nigeria Anchor Borrowers Programme dey owe CBN N463bn as at March 2021, data from CBN Economic Report for April don show.
Video
Maina wey be pension boss, steal moni of pensioners, and e no fit tok where he see plenti from.
Video
FG tok say dem need 7 trillion naira to take fix 854 roads for Nigeria
Video
On Friday evening, some security pipu go de house of Mary Odili. Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) tok say dem no get hand for d epipu wey go de house. Attorney General and Minister of Justice, Abubakar Malami, tok say na Federal Government get hand for de pipu wey go de house.
Video
Permanent Secretary, State House, Umar Tijjani, tok on Thursday say President, Major General Muhammadu Buhari (retd.), don approve make dem make 14-bed space for Presidential Clinic for N21bn
Video
FG don put Diezani Madueke bras, buildings, jewelries for sale
Video
Senate Committee on Local and Foreign Loans, tok say dem no go gree make Federal Ministry of Health borrow 200 million dollars wey be 82 billion naira, take buy mosquito nets for malaria programs for 2022 budget.
Video
Nigeria na part of de few countries wey get digital currency. President Muhammadu Buhari tok for de launch of de digital currency, say eNaira go increase Nigeria GDP by $29billion over di next 10 years.
Video
Police for Osun state don catch 13 prisoners of Abolongo prison for one village wey dey Ejigbo local government for Osun state.
Video
Nigeria Railway Corporation don stop train wey dey go Abuja-Kaduna, sake of say bandits bomb one part of de tarin track.
Video
Information and Culture Minister Lai Mohammed announce for Abuja say na by force make police do psychiatric and drug test. Government dey do dis one ontop de #endsars protest wey happen last year.
Video
13 Niger councils no fit pay salaries of deir workers for over 5 months
Video
Ministries, Departments and Agencies of Federal Government go spend N104bn to buy generators, buy fuel and service dem for 2022
Video
The Supplementary Appropriation Act wey FG sign for July 2021 make dem spend N4.87bn to monitor private calls and messages ontop social media. Dis moni na part of the N895.8bn supplementary budget wey National Assembly approve .
Video
Nigeria Police Force don send over 34,000 Police go Anambra State, for election wey go happen on November 6 The Inspector General of Police (IGP), Usman Alkali Baba tok dis one for meeting wey he do with various state police commissioners and heads of formations for Abuja.
Video
House of Representatives, on Wednesday, tok say de N16.39 trillion 2022 budget, say e too much and if dem borrow again e go affect Naija economy.
Video
Senate Tok Say INEC Fit Use Internet Take Transfer Election Result meaning to say no bi de same way dem dey collect INEC result before dem go use again!
Video
United Nations International Children’s Emergency Fund (UNICEF), tok say more than 1.3 million Nigerian girls dey commot from schools before dem finsh Junior Secondary School evri year.
Video
Pipu dey worry as Business moni from obodo oyinbo don drop by 44%
Video
Plenti politicians for de kontri don spend millions of naira go visit Tinubu for London. Dem tok say na deir moni wey dem use, say no be government moni.
Video
FG don tok say "If dem do anyhow dem go see anyhow"....IF Badness Kontinu dem go declare STATE OF EMERGENCY for Anambra! How you see am?! #chookmouth 👇🏽
Video
Federal Government don approve N75,000 per semester for students wey dey study Education for public universities in Nigeria. Nigeria Certificate in Education (NCE) students go get N50,000 per semester. Government dey do dis one take bring pipu for teaching profession.
Video
Mr. Olajide Kumapayi, Chief Technical Officer, Ikeja Electric, tok for news on Monday for Ikeja, say some places for Lagos no go get light for 8 weeks .
Video
Bandits dey attack shops for Zamfara, collect deir food wey neva reach dem chop
Video
Nigerian Liquefied Natural Gas don tok say price of Gas don go up by 73%
Video
As plenti badness dey shele for Northern states like Zamfara, Katsina, Kaduna ,Borno and oda states. De Senate, yesterday, ask President Muhammadu Buhari make eim call dem as terrorists for de country.
Video
As Nigeria dey borrow moni , 77 oil companies dey owe Naija 2.6 trillion naira
Video
House Of Representatives wan chook eye, find pipu wey dey collect bribe for Nigeria Airport
Video
Different pipu for Sokoto State don describe de attack wey happen for Sokoto military camp inside Sabon Birni local government area of the state by bandits wey dem say na Bello Turji wey lead the terrorist. However, the sources no fit say the number of soldiers wey die for de attack.
Video
Pensioners dey suffer as states neva pay dem deir moni
Video
Federal Government don spend 20 billion on Ajaokuta steel for de past 6 years.
Video
Businesses for Nigeria must accept E-Naira -CBN
Video
FG don shutdown Aboki FX website
Video
Naira free fall don continue as Nigerians dey rush buy dollar
Video
President Buhari wan collect another loan
Video
Tinubu na de only politician wey fit win Presidency, afta Presido Buhari commot - Honorable Ade
Video
ASUU tok say dem go soon go anoda strike
Video
Presido Buhari don confirm say true true, na Igbo pipu dey control Nigeria Economy
Video
Federal Government don approve national policy on 5G
Video
Federal Government go soon begin Tax pipu wey dey do Social media business
Video
Presido Buhari don break plenti beta records - Presidency
Video
13,000 projects get k-leg for delta state, ontop 6 trillion naira wey Federal Government give NDDC
Video
Jamb don cancel cut off mark.
Video
Governor of Edo state, Obaseki, tok say na compulsory make evri bodi for Edo state take Covid-19 vaccine
Video
Lalong wey be Plateau state governor tok say if dem catch dose pipu wey dey kill for eim state, catch , dey no go fit escape oooo!!!!
Video
NNPC pipeline dey leak for ikotun
Video
Lagos state tok say dem dey plan reduce flood wey dey come
Video
Major wey bandits kidnap for NDA don die
Video
Resident doctors wey dey on strike no gree listen to court and Federal Government request
Video
Wazobia fm dey celebrate wit de New Crowned Olu of Warri His Majesty Ogiame Atuwatse III, we wish you Long Life and Great Wisdom to Rule....... May the Kings reign be GREAT!!!
Video
Presido Buhari tok say he no leave officce as failure
Video
Federal Government go spend 658 million naira ontop sniffer dogs for Lagos and Abuja airports
Video
Masari, Governor of Katsina state dey tell eim pipu for Katsina say, mak dem go buy weapons wey dem go use take fight bandits
Video
Federal Government wan borrow 4.98 trillion naira take use do 2022 budget
Video
SERAP dey advice Presido mak eim use de 4.8billion naira wey dem wan use take monitor Whatsapp, pay Resident Doctors wey dey on strike.
Video
Federal Government dey think anoda lockdown
Video
Nigerian Medical Association dey tell Federal Government mak dem close all NYSC camps.
Video
Mambilla Power plant don get anoda wahala
Video
Malaria dey kill 9 pipu every hour for Nigeria
Video
Aso Villa dey shout say dem neva give dem deir full moni
Video
Lagos State don cut down Tinubu, Fashola, Ambode and other former governors pensions by 50%
Video
Lagos state don increase isolation centers as covid-19 cases dey go up
Video
Federal Government tok say na poor pipu dey enjoy fuel subsidy
Video
Police Commission don tell Abba Kyari make he siddon for house.
Video
Hunters wan help fight boko-haram for borno.
Video
Federal Government wan use 30 billion for Covid-19 third wave
Video
CBN don tok say dem no go give Bureau De Change moni again
Video
Cholera don enta 18 states for Nigeria
Video
Bandits don free some bethel baptist high school students
Video
Oyedepo tok say e no gte patience for failure dat na why e sack some pastors
Video
Protest dey for Ibadan make dem release Igboho
Video
Abdul Salami dey beg Bandits make dem no do yaga yaga for salah
Video
Presido Buhari dey complain about things wey cost for Nigeria
Video
Nigeria need global support to stop security wahala
Video
Senate don increase pass mark for Nigeria loans to 61 trillion naira
Video
Anybodi wey tiff ballot box go spend 20 years for prison.
Video
National Intelligence Agency don get 4.87bn to fit track calls and messages.
Video
Bandits kidnap Emir of Kadunna and oda tori
Video
Ogun State tok say 3 years for prsion , for anybodi wey dey do open grazing.
Video
Chief of army staff tok say he don send plenti bandits to baba God.
Video
World bank don commot Nigeria from 4 billion naira covid-19 cash
© Copyright 2024 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.