Super Eagles Don Come Back Naija

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Super Eagles don come back Naija from Libya, after wetin dem been face for the North African country.

Di players later go social media come show dia frustration about di situation wey cause public wahala.

After plenty drama, di Libyan authorities give di Nigerian team di go-ahead to leave di country.

As dem confirm say dem don arrive, di team captain William Troost-Ekong post for im X handle say, “BACK HOME SAFE & SOUND. Proud of dis team, NAIJA SPIRIT no fit break.”


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C