Federal Government say second Niger Bridge go ready dis Christmas to dey use.
Acting controller of works for Anambra, Mr Seyi Martins say di first phase of di second Niger bridge wey measure1 point 6 kilometer, don dey 95% ready.
Mr Seyi Martins, say make u no believe news wey dey fly around say second Niger bridge go ready 2024. He tok say Presido Buhari Administration dey make sure say pipo wey dey travel pass River Niger, no stress go dey at all.