NYSC Allawee: Some Corps Members Dey Ask Weda Di New Allawee Change Anything.

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Some NYSC Corp members dey ask Weda di new Allawee make any difference for dis time wey Nigeria Economy get as e be.

 

Di Nigerian Government don increase NYSC Corp members monthly Allawee from N33,000 to N77,000 to support di youth of di nation. Dem chook eye for di mata for July come announce am September.

Dis increase dey happen after 5 years, wey dem increase Allawee from N19,800 to N33,000. Di new allawee announcement from N33,000 to N77,000 don cause different tok. Some corps members dey happy with di new allawee, while some dey ask weda e change anytin as Nigeria Economy dey suffer inflation.

National Youth Service Corps (NYSC) na one year mandatory program wey Nigerian Government create during military regime, under Head of State Yakubu Gowon to "reconstruct, reconcile, and rebuild" di country after di Nigerian Civil War. Dem establish am on 22 May 1973.

Some pipo wey receive N19,800 more dan 5 years ago tok say di amount get impact and value before, dan 77,000 go get for 2024.

Now di question be say, shey Nigeria fit overlook di economic wahala of dia youth or dem go find solution to protect dia future? As Nigeria dey try find way for di plenty financial challenges, policymakers need to redo di NYSC allawee and di minimum wage to make sure say dey align with how  Nigeria's economy be now .


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 29°C | Low: 25°C