NNPC say dose wey dey tiff Naija Oyel get religion and security support
Nigeria National Petroleum Corporation dey accuse some religious pipo and security pipo say dem dey tiff oil.
NNPC Managing Director Mele Kyari tok dis one for di 49th session of di state house briefing wey presidential communication team organise for Abuja. He also tok say we need oda sources of energy like gas, since petrol demand dey high.