The number of pipu wey dey contest for presido chair for inside the All Progressives Congress (APC) don dey swell up like garri wey dem soak forget, As oga Dr. Chris Ngige don where eim cap to join the waka
The minister of Labour and Employment wey also be before governor of Anambra state, tok this one on Tuesday, for St. Mary’s Catholic Church wey dey eim hometown for Alor inside Anambra State.
Dr. Ngige tell eim pipu wey gather to come show am love, say eim don wear eim canvas, tight eim belt, and wear eim cap. to join the waka to become presido of we obodo naija.
Ngige Dances Ahead Of 2023 Presidential Declaration.................
— OOU PREMIUM (@OOUPREMIUMTV) April 19, 2022
The former Anambra State governor and current Minister of Labour, Dr. Chris Ngige, in a video is seen dancing to the beat of Ogene after declaring to contest for the post of President days back....... pic.twitter.com/KNv8y3huid
Eim also tell oga Muhammadu Buhari, thank you oooo. Because eim allow am serve as a minister for eim government. Oga Ngige don be senator and governor before eim come be minister for this government.
Oga Ngige also be the second minister for President Buhari cabinet wey don come out come tok say dem wan join the waka to become presido. The other minister na Oga Rotimi Amaechi, wey be the Minister of Transportation.