On Air Now

Market Runz

11:00am - Noon

Good News for Nigerians as Petrol Landing Cost Don Drop to N976 per Litre

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Nigerians fit soon see small relief for petrol price as landing cost don drop to N971 per litre, wey dey bring hope say pump price fit go down small for people wey don dey suffer high petrol price.

According to data from the Major Energies Marketers Association of Nigeria (MEMAN), wey use exchange rate of N1,665.84 to $1, dem show say the 30-day average landing cost of petrol to enter tank na N976.73 per litre.

This drop for landing cost mean say pump price for petrol fit reduce across filling stations for the whole country. But, how much the price go come down still depend on different factors, like transport cost, storage, and distribution.

MEMAN data still show say landing cost of diesel (Automotive Gas Oil - AGO) dey at N1,082 per litre, while aviation fuel (Aviation Turbine Kerosene - ATK) dey at N1,135 per litre.


Today's Weather

  • Lagos

    Light rain shower

    High: 32°C | Low: 25°C