Di Department For State Service aka DSS don tok say everywhere dey calm after di US Embassy inside Nigeria yarn about di security warning ontop terrorist mata inside Abuja.
Di person wey dey relate wit di public for DSS, Officer Peter Afunanya tok on
Sunday as im dey advise Naija pipo to dey very alert and make dem folow
help security pipo dem wit beta informate about any threat or criminal
wey dem suspect around dem.
Di US Embassy tok say dem go reduce dia service until further notice.
How U See Di Mata ? #chookmouth