Armed Herders Don Dey Take Over 20 Community For Benue - Ojema

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Remember say e never too tey wey Fulani Bandits take over Egwuma community for Agatu and dem kill 2 soldiers and six pipo.

Member of House of representatives for Apa/Agatu federal constituency for Benue state, Ojotu Ojema don cry out say make Nigerian military continue their work against armed herdsmen wey dey disturb di peace of their communities for Agatu Local Government, Benue State.

He still tok say, presently dem dey occupy 20 communities for di area as dem dey terrorize natives.

Pastor Ojema tok dis one during weekend as some journalists interview am for Makurdi.

Ojema tok say need dey for Nigerian Military to work more and dey proactive to stop di issue.

He still tok say Apa/Agatu axis of Benue na di most abandoned local government area for Nigeria, with insecurity wey dem dey experience.

According to am "Since I don enter National Assembly as representative of my pipo, I don visit Agatu pass 25 times and e dey bother me say everytime I dey come console pipo wey armed herders don attack.

"As I dey tok to you, on Tuesday October 1, as pipo dey celebrate independence, anoda attack happen for Egwuma community wey six pipo die including di community leader and 2 soldiers.

"I go 72 battalion north bank for Makurdi to tell dem say we need soldiers to dey permanently, in di area,and for dat same day herders kill many pipo in di community.

"So, wetin dem need to do na to step up their work. He tok say need dey for di country security weapons to increase their effort to ensure say dem bring freedom and peace to di community, na wetin eim tok.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C