FG Donate 64 CNG Bus Give Labour Union and NANS

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di Federal Government don give ova 64 Compressed Natural Gas (CNG) bus to some pipo of TUC, NLC, and NANS.


Di donation of di buses happen on Sunday for di State House Conference Centre for Abuja, as e dey part of di celebration to celebrate Nigeria 64th Independence Day.

Na di Oga for Finance and Economy  Mr. Wale Edun and oda ministers na  eim Presido Tinubu send go for di ceremony. 

Edun tok say wen dem start dey use di bus for commercial service, e go reduce transport moni.

He still tok say di reason why dem dey share the bus na becos of President Tinubu promise, say he go provide cheap and beta transport to support Nigeria after he don commot fuel subsidy under di Presidential Initiative on Compressed Gas (PCNGi).

He tok say di sharing of di bus, na to reduce di stress wey poor pipo dey go through and support di economy.

Di minister still tok say anoda reason for sharing of di buses for di eve of Nigeria Independence Day na to mark new beginning for Nigeria.

He tok say Federal Government bin wan share ova 500 CNG bus and 100 electric vehicles di first time. He con tok say di CNG plan sit down well with  Nigeria's commitment for clean energy.

He tok say di Federal Government bring dis idea becos of workers to make sure say transport moni dey cheap.

Di Coordinating Minister of di Economy tok say di price of fuel na around one-third of di fuel for vehicles wey dey use petrol.

According to am, drivers fit pay small moni like N15,000 to fill tank instead make dem fill am for N50,000.

"Today na CNG, tomorrow, na to help farmers with wet season and dry season planting, from November, with fertilizer, herbicides,seeds etc

"All dis one na to reduce price and make economy move," na wetin him tok

Comrade Nuhu Toro, di Secretary-general and Chief Executive of TUC; Comrade Lucky Emonefe, NANS President, and Comrade Uche Ekwe, di Head of International Desk,NLC, hail Presido for eim doings.

Dem still tok say dem need more CNG buses to dey available for di public.

 Nuhu Toro come thank President Tinubu for di new N70,000 national minimum wage.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 22°C