Friday, 20 September 2024 - 47 minutes
Religious crisis wey dey cause serious kakata dey happen because people no gree wan recognize and accommodate other people views and opinions on top mata wey concern religion or belief and this issue na im be the major sources of religious violence in Nigeria and the gbege don cost loss of lives and destruction of properties.
Inside the show Katlong Dasat wey be Senior Media Officer inside Search for Common Ground go join Mc Bluetooth on top Una Wake up show inside Area Gist take reason Early Warning and Early response Mechanism wey go help prevent dis crisis make e no turn mata of be careful.
© Copyright 2024 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.