UNGA 79: Tinubu Dey Ask Make Dem Forgive Nigeria Gbese

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

President Tinubu dey beg make dem forgive Nigeria and oda developing countries from creditors and multilateral financial institutions.

Tinubu make di talk wen im dey address world leaders for di General Debate for di 79th Session of di United Nations General Assembly (UNGA) wey dey happen for di UN headquarters for New York, United States.

Dis one dey for statement wey Vice-President Kashim Shettima spokesperson, Mr Stanley Nkwocha, tok on Wednesday.

President Tinubu no show for di global forum, na di Vice-President Kashim Shettima represent am.

Tinubu tok say dem need to reform di international financial system and make di multilateral trading system dey transparent.
 

Di president yarn say if dem adopt di “Pact for di Future,” e fit change di way tins dey go, reposition economies, and turn am to better action plan.

According to am, dis plans go help solve di wahala wey developing and least developed countries dey face.

"Na because of dis and oda reasons wey we dey repeat di call from countries, especially from di global South, for reform of di international financial system and to promote rules-based, non-discriminatory, open, fair, inclusive, equitable, and transparent multilateral trading system," im talk.

Tinubu also warn about di danger if we no follow multilateralism, and draw UN attention go di global debt wahala wey dey affect countries and governments to fit meet di needs of dia pipo.

Im still tok say trade barriers and protectionist policies dey spoil di hope for nations, plus di uncontrollable competition dey kill motivation and hold back global investments.

"Same way, we suppose make sure say any reform for di international financial system include complete debt relief measures.

"Dis go make sure say countries fit get sustainable financing for development. Countries for di global South no fit make better economic progress without special concessions and review of dia current debt burden."

Di president come call make dem recover di money wey corrupt pipo and illegal financial flows don carry waka.

Im hold ground say di return of such money to di countries wey e come from "na fundamental principle of di United Nations Convention against Corruption."


Abuja Weather

  • Abuja

    Thunder storm

    High: 26°C | Low: 20°C