President Tinubu Don Tok About Eim Plan to Change Eim Cabinet - Onanuga

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Special Adviser to Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga tok say Presido get plan to change eim cabinet.

Onanuga tok say " I no sabi weda Presido want change eim cabinet before October 1, but e go do am. Eim never tell us time wey eim go do am but eim go do am".

As we dey tok about di importance of current administration, Onanuga tok say di new Federal Executive Council meeting, di President don already give instructions to all  eim ministers make dem go tok about administration operations.

He come encourage dem say make dem no shy to media, television and radio, make dem tell media their work.

"Becos di feeling for dere na say di government no dey do well and di government dey do plenty things. And e dey up to dem to go blow their trumpet. Make dem tok wetin their ministries dey do."

To tok more on di reason for President Bola Tinubu decision, di Senior Special Assistant to di President on Digital Strategy Engagement and Communications, O'tega Ogra, tok say e dey based on evidence.

"Eim still tok say wen he dey do retreat for ministers, say periodic reviews and decisions go dey, and dem tok say dem go use di decisions wey dem commot from di reviews make final decision.


Abuja Weather

  • Abuja

    Thunder storm

    High: 26°C | Low: 20°C