On Air Now

Non Stop Music

Midnight - 6:00am

Gunman Shoot for Trump Rally For Pennsylvania, One Person Die And Three Wounjur

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Wahala burst for Saturday for rally wey dem do for former President Donald Trump for Butler, Pennsylvania wen one gunman start to shoot anyhow, wey lead to one person die and three others wound.

The gunman, wey dem call Thomas Matthew Crooks, wey be 20 years old from Pennsylvania, eim bin shoot but Secret Service agents take action quick and eim die for the spot.

Donald Trump sef get injury for di assassination attempt and dem rush am go nearby hospital make dem treat am.

President Joe Biden condemn di attack, e call am "sick," and e thank law enforcement people for dem quick response wey save Trump from danger.

After the incident, Biden call Trump and Pennsylvania Governor Josh Shapiro to talk about wetin happun and offer support.

Different politicians from around the world, like former President Barack Obama and UK Prime Minister Sir Keir Starmer, join to condemn the shooting and talk say make everybody join hand for unity and security for face of dis kain violence.

Dem dey still investigate wetin cause the attack as authorities dey find more information about the bad thing wey happun for the political rally.


Abuja Weather

  • Abuja

    Thunder storm

    High: 27°C | Low: 21°C