Di Federal Government don declare Wednesday and Thursday wey bi di June 28th and 29th of june 2023 as public holiday for dis year Eid-el-Kabir.
Na di Permanent Secretary of di Ministry of Interior na eim com out make dis announcement say -
For di spirit of dis ogbonge period say make we observe di good behavior of obedience, sacrifice and faith wey Prophet Ibrahim being teach during eim time. E kon tok all muslims and nigerians suppose make sacrifices for di growth and development of obodo nigeria.
E kon still tok say, E dey hopeful say dis all di prayers and sacrifices wey com wit dis ogbonge season say e go bring about peace, unity abd progress in obodo nigeria. Na wetin e tok for dis mata.
How una see dis mata??
#chookmouth