On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

EFCC Don Carry Cubana Chief Priest Go Court Becos Of Naira Abuse

EFCC don carry Okechukwu Pascal wey many people know as Cubana Chief Priest go Federal High Court for Lagos today (Wednesday). Dem tok say eim dey violate Central Bank Act of 2007 becos eim spray and tamper with naira for party.

According to di charges, EFCC prosecutor, Rotimi Oyedepo (SAN), and seven other legal representatives file di charges on April 4.

For Count 1, dem accuse am say "Okechukwu Pascal, on February 13, 2024, for Eko Hotel, tamper with N500 currency wey Central Bank of Nigeria issue by spraying am for two hours. Dis na against Section 21(1) of di Central Bank Act 2007." Count 2 accuse am say "Okechukwu Pascal, for 2020 for Lagos during social event, tamper with N500 currency wey Central Bank of Nigeria issue by spraying am for two hours. Dis na against Section 21(1) of di Central Bank Act 2007." Count 3 accuse am say "Okechukwu Pascal, for January 2024, for Lagos during social event, tamper with N500 currency wey Central Bank of Nigeria issue by spraying am. Dis na against Section 21(1) of di Central Bank Act 2007."

Remember say EFCC don also convict Bobrisky for becos of dis same mata, and eim chop six-month prison sentence on April 12, 2024. Dem still dey investigate other celebrities wey dem suspect say dey abuse currency.


 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C